a ghanaian social network. meet ghanaians worldwide.
Icon_rss Topic: The cheating Housewife. (1 vote) Add Post
Maame - July 06, 2007

A housewife, realizing that the housemaid had started behaving funny, decided to engage her one morning.

Madam: “Chinyere why you don begin dey behave anyhow these days? E be like Say u no wan know ya mate for this house again o! Face no dey fear face for ya village?”Abi you don carry craze for head?

Chinyere responded immediately: “Look at you, you call yourself Madam…….which kind wife wey u be? After all my food dey sweet pass ur own….”

Madam: “Ehn!!!!! Who told you that you cook better than i do?”

Chinyere: “Na Oga now…….”

Madam: “Lord have mercy!!! Papa Nkechi……..!!!!!!!!?? you will come and meet me in this house today…Na war between me and am today. Ohoooo no wonder…….. I don dey suspect this thing since…….”

Chinyere: “No be all be that o….., I even better pass you for bed…”

Madam: “Yeepa..!!!!!!!!!…. I’m finished!!! So… Papa Nkechi told u such thing too?”

Chinyere: “No, The driver said so.”

Madam: “Uhmm……Chi chi baby, Chinyerryerry Chinlosky come here ehn… Good girl. Abeg no let Oga hear that one. OK….”